For thirty-six years wen Asa dey rule for Judah, King Baasha for Israel kon attack Judah. E put sojas for Rama, so dat nobody go enter or komot from di town.
E klear sey na God dey wosh di whole world and E dey ready to give pawa to doz wey trust am. Yu nor use sense for dis matter, so from naw go, na so-so war yu go dey fight.”