Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kronikles 14:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 King Asa do evritin wey God wont.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kronikles 14:2
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Asa obey God, just as en grand-grand papa David do.


E drive all di men and wimen wey dey do ashawo work for where dem for dey woship juju kon skata di juju wey di former kings make.


Even doh King Asa nor skata evriwhere where dem for dey serve juju, e still dey faithful to God till e die.


King Abijah die and dem beri am for David Town. En pikin Asa kon take-ova as king. Wen Asa dey rule, di land get peace for ten years.


E remove di juju altars kon skata dia stone, den e distroy Asherah juju pole.


King Asa remove en grand-mama, Maaka from en pozishon as kween mama, bikos e make Asherah en juju. King Asa kut di juju kon burn am to pieces for Kidron Valley.


E like to obey God and e skata evriwhere wey dem for dey woship Asherah juju for Judah.


E follow wetin Asa en papa do and e dey kareful and dey do only wetin God wont.


King Jehoram receive dis leta from Profet Elijah: “Dis na wetin yor grand-grand papa, David God tok: yu nor follow Jehoshafat yor papa and King Asa for Judah footstep,


Afta di feast, Israel pipol for Judah kon go skata di pilas, Asherah juju pole, all di high place and altar where dem for dey serve juju for Judah, Benjamin, Efraim and Manasseh tribes. Den all of dem kon go back to dia house.


For Judah, King Hezekaya do only tins wey dey rite, korrect and good for God eye.


E distroy di altar, Asherah juju and di oda juju kon skata all di incense altars wey dey for Israel town, den e go back to Jerusalem.


Make una nor bow or serve dia gods kon do wetin dem dey do. But una must distroy dem finish kon skata dia juju to pieces.


and wi go dey holy and good for en eye as long as wi dey for dis world.’


Make una break di altars and skata di pilas. Make una burn di Asherah juju poles kon kut dia juju. Make una make sure sey una distroy all dia gods!


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ