2 Kronikles 14:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
14 Dem win all di towns near Gerar, bikos God make dis towns run with fear. Judah men karry dia propaty go house, bikos di propaty for di towns many well-well.
Den Samaria pipol rush enter Siria kamp kon pak evritin wey dey der. And as God tok, three kilogram for di best flower or six kilogram for di best korn, dem kon dey sell am for one silva.
King Jehoshafat with en men kon go pak di sojas tins. Dem pak dia klot and many oda betta tins. E take dem like three days to pak all di tins, bikos dem plenty well-well.
Dia king go run komot from en palis bikos of fear; dia ofisas go dey fear wen dem si God war flag.” Dis na God word; di One wey en fire dey burn well-well for Mount Zion.
For dis time, all awa enemies ship rope don slak; di ship don weak well-well! Wi go seize all di propaty wey awa enemies sojas get kon divide dia propaty among doz wey nor fit waka.
From today, evribody wey dey di world, I go put fear for dia mind, bikos of una and even wen dem hear una name, fear go katch dem. Dem go fear nearly die wen dem hear sey una dey kom.”
Wen Amor pipol kings for Jordan River west and Kanaan kings wey dey near di wotaside for Jordan River hear how God take dry Jordan River for Israel pipol make dem waka pass, dem kon bigin fear well-well.
At wons God Spirit enter Samson kon make am strong, so e go Ashkelon kon kill thirty men, den e take dia klot, kon give dem to di men wey solve di problem. Leta, e go back to en papa and mama house kon dey vex bikos of wetin happen.