2 Kronikles 14:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
11 King Asa pray to di Oga wey bi en God sey, “My Oga God! Na Yu dey make weak pipol strong. Wi dey go fight dis many sojas, bikos wi bilive sey Yu go help us.”
Wen Yu kommand yor pipol make dem fight war with dia enemies, if dem pray to Yu from anywhere and dem face dis town wey Yu don choose and dis temple wey I build for Yu,
Na God ensef dey lead us. En priest dey here won blow trumpet, so dat wi go kon fight una. Israel pipol, make una nor fight against una grand-grand papa God, bikos una nor go fit win.”
Awa Oga God, Yu nor go judge dem? Wi nor get pawa rish dis plenty sojas wey dey kom attack us so o-o. Wi nor know wetin wi go do, so wi kom meet Yu make Yu help us.”
Na only human being pawa dem get, but di Oga wey bi awa God dey with us and E go help us fight all awa war.” So, wetin King Hezekaya tok kon make di sojas get strong heart.
But time dey kom wen Israel pipol wey go survive nor go depend on di pipol wey almost distroy dem. Instead dem go only depend and trust Israel God wey dey holy.
So make una stop to trust human being, bikos dem just dey breath thru dia nose. Wetin dis pipol bi sef? So make una stop to trust human being pawa. All of dem go die one day, so how dem won take help una?
Bikos Oga God wey dey rule ova evritin tell mi sey, na bikos of en own glory E send mi go di nashons wey bin distroy una, bikos anybody wey tosh una, don tosh di pipol wey E love well-well.”
God tell Gideon, “I go use dis three hundred men wey drink di wota like dog, take save and give yu viktory ova Midian pipol. So, make yu tell di remainin pipol make dem dey go dia house back.”
Jonatan kon tell en savant, “Kom make wi go di oda side go meet all dis men wey dem nor sekonsaiz. May bi God fit fight for us. Nor-tin go fit stop God to save us, weda dem many or small.”
E dey wosh and guide di pipol wey E choose, but E dey make wiked pipol shut up for di dark place wey dem dey, bikos nobody fit win war with en own pawa.