Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kronikles 13:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 Leta e gada some yeye men wey tell and make King Rehoboam do some yeye tins, bikos di king heart nor strong rish to tell dem ‘No’.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kronikles 13:7
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Even doh na mi God choose to bi king, I dey weak today, bikos dis Zeruaya shidren too sturbon for mi. Make God ponish dis tif, bikos of wetin dem do!”


Make una arrange two jaguda make dem akuiz am sey, e curse God and di king. Den take am komot for di town kon stone am die.”


Leta, di two jaguda kon akuiz Nabot sey, e curse God and di king, so dem take am go outside di town kon stone am die.


Wen di pipol si sey di king nor won listin to dem, dem kon bigin shaut, “Make David and en family get out! Wetin dem don do for us before? Israel pipol; make wi dey go house! Make King Rehoboam kare for ensef!” So Israel pipol bigin argue among diasef


King Rehoboam kingdom kon strong well-well for Jerusalem. E bi forty-one years wen e start to rule and e rule for seventeen years from Jerusalem, di town wey God choose among all Israel tribe as en house. King Rehoboam mama kom from Ammon and en name na Naamah.


Dem nor get sense or name and dem porshu dem komot di town.


I nor get time to spend with lie-lie pipol or waka with dem.


Pesin wey dey work hard, always get plenty to chop, but pesin wey dey porshu dis world tins, nor get sense.


Farmer wey dey work hard, get plenty food to chop, but pipol wey dey waste time for evritin wey dem dey do, na poverty go kill dem.


E go bad for any town wey dia king dey tink like small pikin and dia leaders dey always do party till day break.


God sey, “I go make yong pipol rule dem and na wiked yong men go bi dia oga.


But di Jew pipol dey jealous, so dem kon gada aria boys wey dey waka about for market, take form gang to skata di town. Dem attack Jason house, bikos dem tink sey Paul and Silas dey der, so dat dem go bring dem out kon take dem go di town hall.


My brodas and sistas, make una stop to tink like small shidren. Instead make una dey tink like mature pipol and dey innocent like pikin wey dem just born.


some wiked pipol don leave una go tok to pipol wey dey di land before sey, “Make wi go serve and woship anoda god.” (Gods wey una neva si before.)


Many pipol nor won do wetin God tok, instead, dem dey tok anyhow, dey deceive pipol and follow Jew pipol law wey sey, evribody must sekonsaiz.


E don tey wen una bi Christian, so by naw, una suppose to dey tish odas. Instead, una still wont make pesin kom tish una di first tin wey dey God word. Una still dey drink milk, instead of una to dey chop solid food.


So Jeftah komot from di house kon go stay for Tob town. Na for der e for make sturbon friends kon dey follow dem waka.


Dem gi-am 70 pieces for silva from Baal temple and e use am take go hire wiked men wey nor dey obey di law.


Doz wey dey face trobol or owe pesin or wey nor get wetin to do kon gada follow David and e kon dey lead dem.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ