17 Abijah with en sojas win dem well-well, dem kill 500,000 strong Israel sojas.
Na God ensef dey lead us. En priest dey here won blow trumpet, so dat wi go kon fight una. Israel pipol, make una nor fight against una grand-grand papa God, bikos una nor go fit win.”
Israel pipol run from Judah sojas and God kon let Judah men win dem well-well.
So Judah men win Israel pipol, bikos dem trust and bilive dia grand-grand papa God.
Abijah attack Jeroboam with 400,000 sojas and Jeroboam get 800,000 sojas.
King Pekah for Israel wey Remalaya born, kill 120,000 sojas for Judah, bikos dem turn from dia grand-grand papa God.
So God angel go Assyria kamp for nite kon kill 185,000 sojas. All of dem die before day break!
For God present, mountins dey shake and hills dey melt trowey. Wons God appear, di eart go shake and evribody for di world, go fear.
Abi wi dey try to make Christ vex? Wi strong pass God?