8 But Shishak go win dem, so dat dem go know di difren between to serve mi or oda rulers.”
So today, wi bi slave for di land wey Yu give us. Di betta land where Yu give awa papa dem to chop from and enjoy as e good rish.
Dia enemies opress dem kon make Israel pipol dey do wetin dem tok.
Oga God, difren-difren pipol don rule us, but na only Yu wi go dey praiz forever.
Abeg God, make Yu korrect wi wey bi yor pipol. Make Yu nor ponish us bikos Yu dey vex, if not, all of us go die finish.
But naw, I go gada dem togeda kon ponish dem. E nor go tey before dem go kry with pain wen Assyria king go kom opress dem.
Dis na di nashons wey God leave for di land to take test Israel pipol wey neva fight war with Kanaan pipol before.
E leave doz nashon for der, bikos E won use dem take tish di yong pipol for Israel wey neva fight war before.