Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kronikles 12:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 King Shishak bring 1,200 shariot, 60,000 horse-men and many sojas follow am kom from Egypt, Libya, Sukk and Kush.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kronikles 12:3
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Israel sojas kon porshu Siria sojas go back. David with en men kill 7,000 war horse-men and 40,000 sojas wey dey waka with leg. Dem still kill Shobak wey dey kommand Siria sojas.


bikos God don make Siria sojas hear nois like sey many sojas with dia shariot dey kom fight dem. So Siria sojas tell demsef, “Si, Israel king don go hire Hit and Egypt kings with dia sojas, so dat dem go kom attack us.”


God kon help Asa and Judah pipol and dem kill Kush sojas, while di remainin ones kon run.


King Asa get 300,000 sojas from Judah wey karry shield and spear. E still get 280,000 strong men from Benjamin and dem still karry shield and spear.


Zera wey kom from Kush attack dem with 1,000,000 sojas and 300 shariot. E go Maresha,


Kush and Libya pipol nor get plenty sojas, shariot and many men wey dey ride horse for dem? But wen yu trust God, E kon give dem to yu.


Bikos na Mi bi di Oga wey bi una God. Israel pipol God wey dey holy, wey save una. I go sell Egypt, Sudan and Seba pipol, so dat una go dey free.


“All di sojas wey dem hire kom from Sudan, Libya, Lydia, Arabia, Put and even from among my own pipol, go die for dat war.”


E go kontrol where dem hide gold and silva put with all di betta tins wey Egypt, Libya and Ethiopia bin get.


Na Ethiopia and Egypt bi Tebes pawa before and nor-tin fit stop am; bikos Libya and Put pipol dey kom support am too.


I hear as dia sojas many rish and dem many rish 200,000.


e koll en 900 iron war horse and en men, den dem mash komot from Haroshet-Haggoyim go Kishon River.


Dem go kom with dia kattle and tent wey tick like lokust. Dem go use dia kamel take skata di land


Filistia pipol gada to fight Israel pipol; dem get 3,000 shariot, 6,000 men for horse and dia sojas plenty like san-san wey dey wotaside. Dem kon go kamp for Mikmash wey dey di east side for Bet-Aven.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ