Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kronikles 12:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 King Rehoboam kingdom kon strong well-well for Jerusalem. E bi forty-one years wen e start to rule and e rule for seventeen years from Jerusalem, di town wey God choose among all Israel tribe as en house. King Rehoboam mama kom from Ammon and en name na Naamah.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kronikles 12:13
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Solomon kon love many wimen wey kom from oda kountry. Apart from Fero pikin wey bi en wife, e still marry plenty wimen from Hit, Moab, Ammon, Edom and Sidon kountries.


but I go let Solomon pikin keep one tribe, so dat my savant David, shidren-shidren go fit dey rule for Jerusalem, di town wey I don choose sey dem go for woship mi.


Rehoboam wey bi Solomon pikin, na forty-one years e bi wen e start to rule Judah and e rule for seventeen years from Jerusalem, di town wey God don choose from all Israel aria, as di place where dem go for dey woship am. King Rehoboam mama name na Naamah wey kom from Ammon.


Wen Rehoboam dey rule and don get pawa well-well, en and Israel pipol kon rijet God law.


Leta e gada some yeye men wey tell and make King Rehoboam do some yeye tins, bikos di king heart nor strong rish to tell dem ‘No’.


E tell David sey, ‘Since di day I take my pipol komot from Egypt, I nor choose any town from all di tribe for Israel wey go build di temple wey I go stay or sey I choose one man as pesin wey go lead my pipol Israel.


But naw, I don choose Jerusalem as di place where I go stay and I don choose David make e lead my pipol.’


Wen dem dey read Moses law give di pipol, dem kon rish di place wey sey make dem nor allow any Ammon or Moab pesin join God pipol.


I still tell dem, “Na wimen from anoda kountry make King Solomon sin. Dis man great pass any of di king for oda nashons. God love am kon make am king ova Israel pipol, yet e still kommit sin.


“ ‘Make una use mud build altar for mi kon sakrifice una animals and do peace ofrins for mi. Anywhere wey una for honor my name, I go kom meet and bless una for der.


Di total lengt for di wall for di four side for di town go bi six mile. So, from dat day go, dem go dey koll di town: ‘God Dey Der.’ ”


una must bring evritin wey I kommand una: una burnt ofrin; sakrifice ofrin; tithe and vow ofrin kom di place wey God choose as where dem go for woship and honor en name.


but una must woship di Oga una God for where en ensef go choose from among all di tribes and na der una go for honor en name.


Make no Ammon or Moab pesin enter God present; even to dia tent generashon, make nor of dem enter where God dey.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ