Rehoboam wey bi Solomon pikin, na forty-one years e bi wen e start to rule Judah and e rule for seventeen years from Jerusalem, di town wey God don choose from all Israel aria, as di place where dem go for dey woship am. King Rehoboam mama name na Naamah wey kom from Ammon.
Pipol go ansa, ‘Na bikos dem abandon di Oga wey bi dia God wey bring dia grand-grand papa kom out from Egypt. Dem dey respet and woship oda gods, so God kon give dem dis kind big wahala.’ ”
E use sense put en sons as leaders for Judah and Benjamin aria and oda towns wey dem dey guide well-well. E dey give dem evritin kon marry many wifes for dem.
King Rehoboam kingdom kon strong well-well for Jerusalem. E bi forty-one years wen e start to rule and e rule for seventeen years from Jerusalem, di town wey God choose among all Israel tribe as en house. King Rehoboam mama kom from Ammon and en name na Naamah.
Dia Oga wey bi dia grand-grand papa God, dem leave en temple kon bigin woship Asherah and difren juju. Bikos of dia sin, God kon dey vex for Judah and Jerusalem pipol.
Una own don finish like who don die, bikos una pipol dey kommit sin. Una don spoil finish and dey do evil tins! Una sins dey bring una down, bikos una don rijet di Holy Pesin, wey bi Israel God kon turn against am.
Pipol for dis generashon! Make una listin to wetin God dey tok: “Israel pipol, I bi like desert for una eye naw? Abi, I bi like land wey dark well-well? So wetin make my pipol dey sey, ‘Wi don free from God hand and wi nor nid am again!’
Before-before, wen Efraim pipol dey tok, di oda tribes for Israel dey fear and respet dem. But naw, Efraim pipol dey woship Baal juju and dis tin kon distroy dem.
Una dey obey only King Omri wiked laws and una wiked like King Ahab! So, I go use una as ezample kon distroy una finish. Dem go ponish una and evribody wey si una, go laf well-well.”
But Israel pipol kon fat and wiked more-more. Di pipol kon heavy, round and tick for body! Dem forget God wey kreate dem; den kon rijet di Rock wey bi dia salvashon.