E use sense put en sons as leaders for Judah and Benjamin aria and oda towns wey dem dey guide well-well. E dey give dem evritin kon marry many wifes for dem.
Dia papa give dem gold, silva and many oda good tins with towns for Judah wey dem guide well, but e give di kingdom to Jehoram, bikos na-im bi di first pikin.