20 King Rehoboam still marry Maaka, wey bi Absalom pikin and dem born four sons: Abijah, Attai, Ziza and Shelomit.
Dem born three sons: Jeush, Shemaraya and Zaham.
All Rehoboam wife na eighteen and en girl-friends na sixty. E born twenty-eight sons and sixty dotas. Na Absalom pikin, Maaka e like pass among en wifes and girl-friends
Den Rehoboam die and dem beri am for David Town. En pikin Abijah kon take-ova as king.
For eighteen years wen King Jeroboam dey rule, Abijah kon bi king for Judah.
E rule three years from Jerusalem. Na Maaka wey bi Uriel dota from Gibeah, born am. War kon start between King Abijah and King Jeroboam.
Solomon born Rehoboam, Rehoboam naim bi Abijah papa and Abijah kon born Asa,