17 Dem support Judah kon obey Solomon pikin, King Rehoboam for three years. Dem follow David and Solomon laws for three years.
King Rehoboam marry Mahalat wey David pikin, Jerimot born and en mama na Abihail wey Jesse pikin, Eliab born.
Wen Rehoboam dey rule and don get pawa well-well, en and Israel pipol kon rijet God law.
But God tell dem, “Israel and Judah pipol, wetin I won take una do? Bikos di love wey una get for mi dey kwik disappear like dew for morning; like dew wey dey vanish wen day dey break.