Afta e don tink am well-well, e make two melu image with gold kon tell en pipol, “Israel pipol, e don tey wen una dey go woship for Jerusalem. Naw, make una si di god wey bring una kom out from Egypt!”
King Jeroboam for Israel nor still shange from di bad tins wey e dey do, but e kontinue to dey choose priest from ordinary family make dem kon serve for di altar wey e build. Na pipol wey just like to bi priest, e dey make priest.
Shebi yu porshu Levi pipol and God priest wey bi Aaron shidren-shidren? Yu put doz wey nor suppose bi priest for dia place, just as oda nashons dey do. Anybody wey kom with seven melu or seven ram fit bi priest for dat fake juju wey yu koll god.
Instead make dem sakrifice give God, dem dey sakrifice give juju and gods wey dem nor know; new gods wey dem just si, even gods wey dia grand-grand papa dem nor know about.
Na dem bi demon spirit wey dey do mirakle. Na dem dey go gada all di kings wey dey for di world, so dat dem go fight di fight wey go happen for di day wey God Almighty go judge di world.