6 King Rehoboam ask di old men wey bin dey advise Solomon sey, “Wetin una wont make I tell dis pipol?”
Den Absalom tell Ahitofel, “Naw wey wi don dey here, wetin yu advise make wi do?”
Rehoboam ansa, “Afta three days, make una kom back and I go give una my ansa.” So, dem kon go.
I tell mysef sey make una tok, bikos una wey don old fit get wisdom wey una go share.
Foolish pipol dey always tink sey wetin dem dey do dey korrect, but wise pipol dey listin to odas.
If yu dey listin to advise and dey ready to learn, yu go wise one day.
Make yu nor forget yor friends or yor papa friends, bikos if yu dey trobol, yu nor nid to ask yor relashon for help. Di neighbour wey dey near yu, fit help yu pass yor relashon wey dey far.
make una nor make big mistake. Na una sey make I pray give di Oga awa God and una promise sey una go do evritin wey E kommand.