2 Kronikles 10:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
14 as di yong men advise am. E sey, “My papa give una hard work, but I go make una work hard well-well. My papa dey flog una with ordinary kane, but I go flog una with koboko!”
Dis na how God wont make e bi, so dat wetin E tell Profet Ahijah for Shiloh sey make e tell Nebat pikin, Jeroboam, go fit happen and na dis make di king nor listin to di pipol.
And who go fit know weda di one wey go kom afta mi go dey wise or foolish? But dem go kontrol evritin wey I work for, for dis world! So, make una si as evritin dey yuzles!
All of us wey dey rule yor kingdom, doz wey dey wosh wetin wi dey do; di kounselor, wise men and all di oda royal men, don gri sey make yu give orda kon back am with pawa sey, ‘For thirty days, anybody wey pray to any god or human being wey nor bi yu, make dem trow am for lions pit.’