10 Dem ansa, “Make yu tell dem, ‘I hard pass my papa, Solomon!’
Rehoboam travel go Shekem, bikos Israel pipol don gada for der to make am dia king.
Yu go still tell dem, ‘My papa give una hard work do, but I go make di work hard well-well. Na ordinary kane e take flog una, but na koboko I go take dey flog una!’ ”
“Wetin una wont make I do? Wetin I go tell dis pipol wey sey make I sorry for dem?”
Wise pipol dey kollect all di wisdom wey dem fit get, but wen yu hear foolish pipol dey tok, yu go know sey trobol nor dey far from dem.
Wise pipol dey tink before dem do anytin, but foolish pipol nor dey tink and dem dey happy sey dem foolish.
Wise pipol get sense and dem dey avoid wahala; but foolish pipol dey waka enter trobol.
My pikin, if yu stop to learn, yu go forget evritin wey dem tish yu.
Yor wisdom, brain and undastandin nor mean anytin if God dey against yu.
To get long-trot dey only kause trobol, so e betta make yu trust God.
Pesin pride go distroy am, but if e dey honbol, pipol go respet am.