Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kronikles 1:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 God tell Solomon, “Yu nor ask for money, propaty and honor, or pawa to revensh yor enemies or for long life, instead yu ask for wisdom and undastandin, so dat yu go fit rule my pipol well;

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kronikles 1:11
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Evribody for di world dey won kom hear di wise tins wey God give Solomon to tok.


Wen Israel pipol hear how Solomon take judge di kase, all of dem kon dey respet am, bikos dem know sey na God gi-am di wisdom wey e take dey judge well.


but God tell am, ‘Yu do well as yu won build temple for mi,


David stand for dia front kon sey, “My kountry pipol, make una listin to mi. I bin won build betta house for God Kovenant Box, where God go stay. I don prepare tins to take build betta temple for God.


naw, wisdom and undastandin, na yor own. I go still give yu money, propaty and di kind honor wey pass evry oda king wey dey before and wey go dey afta yu.”


Wise pipol know where dem dey go, but foolish pipol dey deceive demsef.


bikos e go sey, “Make yu kom chop!” But e nor really tok am from en heart, bikos na as e dey tink, na so too e bi.


I dey help kings rule well kon make rulers give korrect laws to dia pipol.


Before una sell di land, nor bi una own propaty? Naw wen una sell am finish, di money nor still bi una own to spend as una like? Wetin make una get dis kind mind? Dis lie wey yu tok so, nor bi pesin yu do am to, but na God!”


God word dey alive, e get pawa and e sharp pass knife wey get two sharp side. Di word dey divide pesin soul from en spirit and e dey divide bone from bone; bikos God know wetin wi dey tink for awa mind.


Who get sense among una? Di way di pesin dey bihave go show di gentolness wey wisdom dey bring.


But God wisdom dey pure; e get peace; dey gentol; dey asept pipol and good fruit and mesi full am; e nor dey do wayo or pritend.


But God tell Samuel, “Make yu nor happy, bikos of how en face look, bikos nor bi en I choose. God nor dey si tins di way una dey si am. Pipol dey look pipol from how dem bi for outside, but God dey look pipol from how dem bi for dia heart.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ