9 Just as dem rite for God word, “E don skata for evriwhere, e don give to poor pipol and en raitiousness, go dey forever.”
Dia house get plenty good propaty with money and dia respet na forever.
Dem dey share and give wetin dem get to poor pipol for free. Pipol go always remember dia good work forever. Dis kind pipol, go get respet and honor.
Make yu dey do good and tok trut and yu go get long life; den odas go respet and trit yu well.
I get propaty, honor, betta life and suksess to give pipol wey wont am.
Dem go vanish like klot wey ant chop! But wen I diliver una, e go last forever; my viktory go last forever.”
And naw wi get faith, hope and love. But di one wey big pass for di three, na love.
Bikos na God dey give seed to farmer and provide bread wey pipol go chop. Like dis too, E go provide and di tins wey una nid, go plenty well-well and dem go last forever.