Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Korintians 9:15 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

15 Na dis make us dey tank God for dis gift wey pesin mout nor fit tok.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Korintians 9:15
23 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Make una pray kon sey, ‘Awa Oga God, make Yu kom save us! Make Yu gada us kon save us from dis nashons! Den wi go tank and praiz yor name wey dey holy.’


“Make una tank and koll God name! Make una let di whole world know di tins wey E do!


so dat I go sing praiz Yu and I nor go kwayet. So, I go tank Yu wey bi my Oga and God forever!


All of una wey dey fear God, make una sing to am!


E dey good to tank God. Yes! Awa belle dey sweet us wen ever wi dey sing and praiz di Most High God.


God tell mi, “My savant, I get big work for yu; yu nor go only make Israel pipol wey survive, great again, but I go still make yu di lite for di nashons, so dat all di world go dey save.”


Bikos dem don born one pikin for us! God don give us boy pikin! E go bi awa ruler and dem go koll am, “Wonderful Advise, Mighty God, Everlastin Fada and di Prince wey bring peace.”


“Na only God get Glory for heaven and eart, make peace and favor dey with evribody.”


For dat time, e kom meet Josef, Mary, di pikin and Simeon kon bigin tank God, dey tok about di pikin give evribody wey dey wait for di time wen God go free Jerusalem.


Evribody for dis world don receive plenty good tins from am.


“God love di pipol wey dey dis world well-well, so E kon send di only pikin wey E get to us, so dat anybody wey bilive am, nor go die, but e go get life wey nor dey end.


But two of dem nor bi di same, bikos God free gift nor bi like Adam sin. Na true sey many pipol die bikos of one man sin. But God grace big well-well and e dey give free gift to pipol thru en pikin Jesus Christ!


Bikos, di reward for sin, na deat, but God gift wey Jesus Christ dey give us, na life wey nor dey end.


True-true, if E let dem kill en own pikin for awa sins, den E go fit give us evritin wey wi ask from am free of sharge!


So, make wi tank God wey give us viktory thru awa Oga God Jesus Christ.


But make wi tank God wey make us winners inside Christ. Bikos thru us, many pipol don know tins about Christ, like betta perfume wey dey smell for evriwhere.


E go make una get enough money for evritin, so dat evritime, una go fit dey give well-well and di pipol wey una give money, go always dey tank God.


So, bikos of God big grace wey E give una, pipol dey pray for una with strong love.


With awa Oga God Jesus Christ name, make una dey tank God awa papa for each oda.


bikos evry betta and pafet gift dey kom from God. E dey kom down from di Papa wey kreate lite and E nor dey shange.


Wen ever di for creatures dey tank, praiz and honor di Pesin wey sidan for di throne wey dey alive forever and ever,


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ