Zabud from Zadok family wey dey head all di priests kon sey, “Since dem bigin bring all dis tins kom God Temple, wi dey get plenty to chop and e dey remain. God don bless en pipol, naim make all dis ones still remain.”
If wi dey prish, make wi prish well. If wi dey give, make wi do am with betta mind. If wi dey lead odas, make wi do awa best. If wi dey do good to odas, make wi do am with happiness.
As una don join dey pray for us, na so too God go ansa all di many prayers wey una dey pray for us, den E go bless us and many pipol go kon tank am, bikos of wetin E dey do for us.
bikos of di work wey di broda dey do, di church don choose am as di pesin wey go dey follow us travel as wi dey give dis good gift, so dat all di glory go bi God own and dis go show sey wi dey ready to help.