Abeg Titus make e visit una and I send dat broda make e follow am kom. Dem play una wayo? Nor bi di same mind wi awasef take follow una? Abi nor bi di same way wi dey bihave?
bikos of di work wey di broda dey do, di church don choose am as di pesin wey go dey follow us travel as wi dey give dis good gift, so dat all di glory go bi God own and dis go show sey wi dey ready to help.
But for Titus, en na my patina and e dey follow mi work to help una. As for di oda brodas wey dey follow am, na all di church sey make dem kom meet una, so dat dem go tell una about di glory wey dey inside Christ.
Naim make mi beg dis brodas make dem go for my front before di time go rish and make dem help una arrange di money wey una promise, so dat una go do am with una mind and nobody go force una.