Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Korintians 8:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 Dem dey do like dis, nor bi only as wi wont am, but na bikos dem don first give demsef to God, den dem kon give demsef to us as God wont.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Korintians 8:5
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den one spirit enter Amasai wey dey lead Di Thirty, so e kon sey, “David, Jesse pikin, wi dey yor side! E go betta for yu! E go betta for doz wey dey help yu! True-true, yor God dey yor side!” So David welkom dem kon make dem ofisas among en sojas.


God still help di pipol kom togeda for Judah, bikos dem obey di king and en ofisas kommand.


Make una nor dey sturbon like una papa, but make una obey God as una dey kom en house wey E don make holy forever. Make una serve am forever, so dat E nor go vex for una.


Afta I don bring Israel pipol kom back to dia land, dis na di new kovenant wey I go make with dem: I go put and rite my law for dia heart. I go bi dia God and dem go bi my pipol.


I go test di third part wey survive kon klean dem, just as dem dey klean silva for fire. I go test dem, just as dem dey test gold. Den dem go pray give mi and I go ansa dem. I go tell dem sey dem bi my pipol and dem go sey, ‘Na di Oga bi awa God.’ ”


My brodas and sistas, God dey good. So Abeg, as una dey alive, make una dey offa una body gi-am as sakrifice. Make una dey do wetin E tok and wetin go make belle sweet am. Na dis bi di best way to serve God.


Make una nor let Satan use una body take do bad tins, but make una karry unasef give God as pipol wey don wake-up from deat, so dat una go dey do good tins.


Na Paul, wey God koll to bi Jesus Christ apostle and Sostenes, awa broda, na dem rite dis leta.


Wi nor dey tok about awasef, but wi dey prish sey, na Jesus Christ bi Oga God and wi bi una slave, bikos of am.


Awa brodas and sistas, wi don tell una about di grace wey God give di pipol for di church for Masidonia sey,


Naw, I don gi-am to God. From today go, I dey dedikate am give God.” Den, dem kon woship God for der.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ