Like dat too, make yor lite shine well-well for where pipol dey, so dat dem go si di good tins wey yu dey do, wey go make dem praiz yor Papa wey dey heaven.”
Wi nor bi like odas wey dey do God word like sey na sometin wey dem fit sell; but bikos na God send us kom, wi dey tok di trut for en present, as Christ savant.
So wi dey send awa broda follow dem; awa broda wey wi don test plenty times kon si sey e get di mind to help and e ready to help naw, bikos e trust una well-well.
Finally, my brodas and sistas, tins wey bi true; wey get respet; wey fine; wey pipol dey tok good about; wey good well-well; wey rish to praiz, na dis kind tins una suppose to dey tink about.
So make una dey live well among pipol wey nor bi Christian, so dat wen dem sey una do bad, dem go si di good tins wey una dey do and dem go praiz God wen E won judge di world.
So Rut sleep near am until morning rish. E wake-up wen day neva break well-well, bikos Boaz sey, “I nor wont make pipol know sey woman kom meet mi for here.”