I nor tell anybody wetin God put for my mind make I kom do for Jerusalem. Den for mid-nite, I wake-up kon take some among my men follow body with only one donkey wey I ride.
I go make kovenant wey nor dey end with dem sey I nor go ever stop to do good tins for dem and I go make dem fear mi with all dia heart, so dat dem nor go turn leave mi again.
Wi kon dey happy, nor bi only sey Titus kom, but bikos of di advise wey una gi-am, bikos e tell us how una won si mi; how una dey vex and worry for mi and my happiness kon pass as e bi before.
But for Titus, en na my patina and e dey follow mi work to help una. As for di oda brodas wey dey follow am, na all di church sey make dem kom meet una, so dat dem go tell una about di glory wey dey inside Christ.