bikos of di work wey di broda dey do, di church don choose am as di pesin wey go dey follow us travel as wi dey give dis good gift, so dat all di glory go bi God own and dis go show sey wi dey ready to help.
I bi witness sey dem dey give akordin to wetin dem get. Sometaim, dem dey give pass wetin dem get. Nobody dey force dem to do like dat, but dem dey do am from dia own mind
bikos I know sey una one help dem. I always dey boast give Masidonia pipol sey, una wey dey Akaia, dey always won help and una don ready to give money since last year. And di way wey una dey won help, don make some for dem won help too.