I tell una true word, na for una own good naim make mi won go, bikos if I nor go, di Pesin wey go help una nor go kom, but if I go, I go send am kom meet una.
Evry Sunday, make each pesin dey keep some money for korna from di one wey e don work, as God help am rish, so dat una nor go nid to kollect money wen I kom.
Some among una sey, “Wi fit do anytin wey wi wont.” But I dey tell una naw sey, nor bi evritin dey good for us. So I nor go gri make anytin kontrol mi.
Koncerning pipol wey neva marry before, I nor get any kommand from Christ to give una, but I go advise una as pesin wey una fit trust, bikos God dey show mi mesi.
bikos I know sey una one help dem. I always dey boast give Masidonia pipol sey, una wey dey Akaia, dey always won help and una don ready to give money since last year. And di way wey una dey won help, don make some for dem won help too.