Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Korintians 7:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 Bikos even if I make una vex with my leta, e nor pain mi sey I rite am (even doh e pain mi as I know sey e make una vex, aldo una vexnashon nor tey).

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Korintians 7:8
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Even doh sey E dey make us sofa naw, E still dey sorry for us, bikos en great love for us nor dey end.


But una nor happy as I dey tell una all dis tins.


Jesus ask am di third time, “Simon, John pikin, yu sure sey yu love mi so?” Pita kon dey vex, bikos e pain am well-well, as Jesus ask am di same kweshon three times, “Yu sure sey yu love mi so?” Den Pita sey, “Oga God, yu know evritin, yu know sey I really love yu.” So, Jesus tell am, “Make yu feed my sheep.


Naw, make una si wetin dis vexnashon wey God plan don do for una: Si how una work for God bi naw; si how una won show sey una hand klean; si as una dey vex bikos of di bad tin wey happen; si how una dey sopraiz; si as una dey won si and worry about us; si how una ready to ponish anybody wey do bad! For evritin, una don show sey una hand klean for dis matter.


I nor rite dis leta give una bikos of di pesin wey do bad or di pesin wey dem do di bad to, but na to show una how una won work for God bikos of us.


But God wey dey help pipol wey nor happy, naim kon help us wen Titus kom.


Wi kon dey happy, nor bi only sey Titus kom, but bikos of di advise wey una gi-am, bikos e tell us how una won si mi; how una dey vex and worry for mi and my happiness kon pass as e bi before.


Naw I dey happy, nor bi bikos una dey vex, but bikos una vexnashon make una turn from sin kom meet God. Na so God plan una vexnashon, so dat bad tins nor go happen to una bikos of dis vexnashon wey wi kause for una.


I dey korrect and ponish anybody wey I love. So make yu dey sirious kon turn from sin kom meet God!


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ