Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Korintians 7:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 But God wey dey help pipol wey nor happy, naim kon help us wen Titus kom.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Korintians 7:6
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

For dat time yu go sey: “Oga God, I praiz Yu, bikos Yu bin dey vex for mi, but naw, Yu dey konfort mi and Yu nor dey vex again.


God sey, “Na mi dey give una pawa. So why una dey fear ordinary men wey nor go last pass grass?


Na mi bi di high and holy God, di Pesin wey go live forever. Where I dey stay, dey high and holy, but I still dey stay with pipol wey dey honbol and ready to turn from sin kom meet mi, so dat I go give dem mind and hope again.


I don si how dem dey bihave, but I go heal dem. I go lead and help dem and I go konfort doz wey dey mourn.


Den di yong wimen go sing with joy, while di yong and old men, go dey happy. I go konfort dem kon turn dia kry to joy and dia sorrow go bi happiness.


God go bless una wey dey mourn, bikos E go make una happy.


Den I go ask my Papa and E go send una anoda Pesin wey go help and stay with una forever.


So, I pray sey, God wey dey give konfort and patient, go help una live for peace with one anoda as una dey follow Jesus Christ,


So, Christ don make awa mind strong. Even as awa heart don strong rish, wi dey happy more-more for Titus wey kom, bikos all of una don let en mind rest.


I don boast gi-am about una and una nor let mi shame, but as evritin wey wi tell una na true, na so all di boast wey wi boast about una give Titus, na trut too.


Wi kon dey happy, nor bi only sey Titus kom, but bikos of di advise wey una gi-am, bikos e tell us how una won si mi; how una dey vex and worry for mi and my happiness kon pass as e bi before.


Gain dey to serve Christ? Konfort dey for en love? Fellowship dey between pipol and God Spirit? Una heart good rish to show pipol mesi?


So wi kon send Timoti, awa broda wey dey follow us do God work sey, make e kom enkourage una koncerning una faith,


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ