(Na shame for mi, but I must tell una sey awa heart nor strong rish to do una doz kind tins!) But anytin wey anybody fit boast about (I dey tok like fool naw o-o), misef fit boast about dat tin too.
But make wi tank God wey make us winners inside Christ. Bikos thru us, many pipol don know tins about Christ, like betta perfume wey dey smell for evriwhere.
I don boast gi-am about una and una nor let mi shame, but as evritin wey wi tell una na true, na so all di boast wey wi boast about una give Titus, na trut too.
and bikos of di prison wey dem put mi so, almost all di brodas and sistas faith for Christ, don strong well-well. And naw, dem don dey prish God word without fear.
Di hope wey I get bi sey, shame nor go ever fit katch mi; my heart go strong well-well and as I dey do naw, na so I go always dey do. Evritin for my body go praiz Christ, weda I dey alive or I don die.
Before wi kom meet una for Tesalonika, dem sofa and trit us anyhow for Filippi and many pipol nor wont make wi tok, but awa God give us pawa to prish en Good News.