E go wear good judgement for body like war koat kon wear viktory like priest kap for en head. E go wear klot wey go make am do good tins kon ponish doz wey dey sofa pipol.
Den, di disciples go evriwhere for di aria dey prish di gospel and Jesus dey do many mirakles thru dem, so dat pipol go know sey, wetin dem dey prish, na true.]
True-true, bikos e nor show en pawa, na dat make dem fit nail am for cross, but e dey alive naw, bikos of God pawa. Aldo wi dey weak with am, but wi go dey alive togeda with am, bikos of God pawa wey wi get.
Wi nor bi like odas wey dey do God word like sey na sometin wey dem fit sell; but bikos na God send us kom, wi dey tok di trut for en present, as Christ savant.
But wi don stop to dey do wiked tins wey pipol dey hide dey do; wi nor dey do wayo or lie join God word, but with trut wey evribody fit si, wi dey make evribody know for dia mind sey, wetin wi dey do, dey good for God eye.
I don boast gi-am about una and una nor let mi shame, but as evritin wey wi tell una na true, na so all di boast wey wi boast about una give Titus, na trut too.
Make yu do evritin wey yu fit do, so dat God go si yu as betta pesin. Dey do yor work well as pesin wey nor dey shame, but dey ready to esplain God word wey bi trut.