but make dem nor for kause trobol, make yu go trow hook for river. Di first fish wey yu go katch, wen yu open en mout, yu go si money for inside, den make yu take di money pay di tax for mi and una.”
So, if wi nor do sometin, awa business go spoil and nor bi only dat one, but pipol nor go respet di temple wey awa juju, Artemis, dey stay again and dis woman wey di whole Asia dey woship, nor go get pawa again.”
If odas dey do like dis, dat mean sey wi even get betta rite to do like dat too. But, wi dey bear evritin, so dat wi nor go kause trobol for Christ message.
Wen I dey with pipol wey get weak faith, I dey live as dem dey live, so dat I go fit win dem. I dey do evritin wey I fit do, so dat I go fit win evribody wey I fit win, kom meet Christ.
Wi dey happy, bikos wi know sey di way wi dey live awa life for dis world and how wi dey bihave with una, dey show sey na God send us thru en pawa, nor bi human being own.