Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Korintians 6:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 Wi nor dey whole awa love from una, but na una dey whole una love from us.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Korintians 6:12
9 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

God remove yu from trobol kon make yu dey save and yu get food full yor tabol.


Nor-tin go stand for yor way if yu dey live wise life, den yu nor go fall wen yu dey run.


So, make yu enjoy wetin yu get, instead of wetin yu wont and stop to dream of tins wey dey yuzles, like pesin wey dey porshu breeze.


Israel pipol suppose tok like dis? God Spirit go get patient with dis kind karata? But if una go gri do wetin dey korrect, my word go konfort una.


But di gate wey pipol dey pass enter life, small well-well and e hard to enter and na only few pipol go fit si am.”


Wi dey face wahala for difren korna, but awa body nor skata; wi dey konfuse sometaim, but wi nor dey luz hope,


Make una allow di gospel enter una heart bikos wi nor do bad to anybody or fall anybody business or play anybody wayo.


God know sey, bikos of Christ love wey dey my heart, I dey miss una well-well.


But pesin wey get enough tins and e nor sorry for en broda or sista for Christ wey nor get at-all, na how God love go take dey inside am?


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ