Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Korintians 5:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 So wi dey always get di mind sey wi go die komot from dis world, so dat wi go-go stay with Jesus Christ for where e dey.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Korintians 5:8
22 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Yu don show mi di way wey dey give life kon give mi joy for yor present and I dey happy to stay with Yu forever.


Bikos I dey raitious, I go si Yu. Wen I don leave dis world kom meet Yu, I go si Yu face-to-face and belle go sweet mi.


Na trobol dey distroy wiked pipol, but doz wey dey fear God, go get life afta dem don die.


“En oga kon tell am, ‘Yu bi good and wise savant and yu do well! Since yu fit use di small tin wey I give yu, e show sey yu go fit kontrol big-big tins. Make yu kom enjoy with mi!’


“En oga tell am, ‘Yu bi good and wise savant and yu do well! Since yu fit use di small tin wey I give yu, e show sey yu go fit kontrol big-big tins. Make yu kon enjoy with mi!’


“Naw, as yor word tok, yu, God wey dey rule evritin, make yu let yor savant go rest.


Anybody wey ready to serve mi, go must follow mi and where I dey, na der my savant go dey too. Anybody wey serve mi, my Papa go honor am.


Wen I don finish, I go kom take una, so dat una go stay with mi for where I dey.


Papa, I wont make di pipol wey yu give mi stay with mi for where I dey, so dat dem go si di glory wey yu give mi, bikos yu love mi before yu kreate di world.


But Paul ansa, “Wetin una dey do so, una dey kry dey won break my heart? I ready, nor bi only make dem tie mi, but to die for Jerusalem, bikos of Jesus Christ name.”


So, wi dey always get mind and wi know sey, as long as wi dey alive for dis eart, wi nor dey where God dey,


So, weda wi dey alive or wi don die, wi dey do evritin wey wi fit do to make Christ happy.


My friends, wi bi God shidren naw and wi neva know as wi go bi wen Christ go kom back. But wi know sey wi go bi like am, bikos wi go si am just as E bi.


Anytin wey God don swear for, go vanish. God and di Lamb throne go dey for dat town and en savants go woship am for der forever.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ