Evritin wey wi dey si naw bi like ordinary image for mirror; but for dat time, wi go si am, face-to-face. Naw wi nor know evritin, but den wi go know, just as God really know us.
Wi nor dey look for wetin eye fit si, but na wetin eye nor fit si. Bikos wetin eye fit si nor go last, but di tins wey eye nor fit si, dey last forever.
I don die with Christ for cross, so nor bi mi dey live again, but na Christ dey live inside mi. Di life wey I dey live naw, na bikos of di good tins wey God pikin do inside mi, bikos e love and die for mi.