Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Korintians 3:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 Di ministry wey dem rite for slate bring deat kom and di glory wey follow am, nor let Israel pipol fit look Moses face. If di glory wey dey Moses face, fade bikos e dey under di law,

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Korintians 3:7
38 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

God use skin take make garment for Adam and en wife kon give dem make dem wear.


Yu kom down from heaven kon tok to dem for Mount Sinai; Yu give dem betta judgement, laws, korrect tishings and kommands.


My God, e don tey wen I dey wait make Yu kom save mi, bikos na yor laws dey give mi hope.


My God, si as I love yor laws and I dey tink about dem evriday.


Den God tell Moses, “Make yu klimb di mountin and I go give yu di law and kommand wey I rite for small flat stone, so dat yu go fit tish di pipol.”


Wen God don tok to Moses finish for Mount Sinai, E kon gi-am two stones wey E rite di kommandment put.


Wen Moses waka near di kamp kon si di melu and di way di pipol dey dance, e vex well-well. E trowey di stones wey dey en hand and dem kon break to pieces.


God kon tell Moses, “Make yu kut two stones kom out like di first ones wey yu skata, den I go rite di same word put for dis ones.


Evribody wey dey di kansol dey look Stefen kon si sey en face dey shine like angel own.


Since Jesus Christ kom, di law nor get pawa again and anybody wey bilive God, go dey raitious.


Di law dey bring God vexnashon, bikos where sin nor dey, law nor go dey.


Di law kom so dat sin go inkrease, but where sin get pawa, God grace strong pass am


and I kon die. So di law wey suppose give mi life, don kill mi!


I dey like to obey God law with my whole mind,


Wen wi still dey di world, di law dey make us do bad tins wey awa body wont and all dis tins dey bring deat.


But one day, wetin dey pafet go kom and wetin nor dey pafet, go vanish.


E klear sey na Christ rite dis leta by ensef kon send am thru us. Nor bi biro dem take rite am, but na di God wey dey alive Spirit dem take rite am, nor bi for paper, but na for awa heart.


Na God make us fit do dem, so dat wi go serve di new kovenant; dis nor bi di law wey dem rite, but na di one wey koncern God Spirit, bikos di law wey dem rite dey bring deat, but di Spirit dey give life.


den how di Spirit ministry wey get glory, go kon bi, since e nor dey fade?


Pipol wey dey under di law and dem nor dey do evritin wey di law tok, dey under curse, bikos dem rite am sey, “E nor go betta for anybody wey nor dey do evritin wey dey di law.”


So di law dey against God promise? No! Bikos if di law dey give pesin life, den raitiousness go must kom thru di law.


E give una en kovenant. E kommand sey make una dey obey di ten kommandment wey dem rite for two stone.


Na wish oda great kountry get rules and law like di ones wey I tell una today?


God tell una dis tins from inside di fire as una gada for di mountin. E shaut tok from di fire wey kloud and darkness kover. Dis na all di tins wey E tok dat time and E rite dem for two stones kon give dem to mi.


So I turn komot di mountin as di fire still dey burn and di two kovenant stones dey my hand.


Una don rish Mount Sinai, where God for tok to Israel pipol. For der, fire dey burn, darkness dey der and storm and


Just as dem dey praiz pesin wey build fine house, pass di house wey e build, na so too Jesus glory betta pass Moses own well-well!


Di gold altar where dem dey burn incense and di Kovenant Box wey dem kover with gold, dey der too. Di gold jug wey dem put manna, Aaron rod wey grow leaf and di flat stone wey dem rite di law put, dey inside dis box.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ