Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Korintians 3:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 Wi nor dey sey wi go fit do all dis tins by awasef, but na God give us di pawa wey wi take do dem.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Korintians 3:5
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Josef kon ansa Fero, “I nor get dat kind pawa, but God go tok thru mi, so dat yu awa king go dey okay.”


God still help di pipol kom togeda for Judah, bikos dem obey di king and en ofisas kommand.


bikos I go give una di word wey una go tok and wisdom wey una enemy nor go fit oppoz.


I dey send wetin my Papa promise kom meet una. So make una stay for dis town until pawa go kom from heaven kon kover una.”


“Na mi bi di vine and na una bi di branches dem. Di pesin wey stay inside mi and I stay inside am, go bear plenty fruit, bikos without mi, una nor go fit do anytin.


With betta mind, evritin wey I dey tok about, na how Christ let mi tok and work, so dat Gentile pipol go obey am.


But God kind! I bi wetin I bi and God mesi for mi, nor bi yeye tin. I dey work pass any oda apostle; aldo na God grace dey help mi.


Na God grace make mi sabi build well-well. I lay foundashon wey anoda pesin build put. But make wi take kare as wi dey build,


I dey plant di seed and Apollos dey wota dem, but na God dey make di seed grow.


But e tell mi, “Di grace wey I give yu strong rish, bikos my pawa dey show wen yu dey weak.” So, I go boast well-well about how I nor dey strong, so dat Christ pawa go dey show for my body.


To doz wey don lost, e bi like sometin wey dey kill; but for doz wey Christ don save, e bi like smell wey dey give life. So, who go fit handle all dis tins?


But dis betta tin wey God give us, wi dey karry am for inside awa body wey go die like klay pot wey break and na God give us di pawa.


bikos na God dey work inside una and una go fit do good tins kon get di pawa wey go make una happy.


I fit do evritin thru Christ wey dey give mi pawa.


Di tins wey yu hear mi tok for pipol present, make yu tish oda pipol wey yu trust sey dem dey ready to tish odas.


bikos evry betta and pafet gift dey kom from God. E dey kom down from di Papa wey kreate lite and E nor dey shange.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ