So e dey good for mi to dey tink about una like dis, bikos una dey my heart. Una don follow mi share from God favor, even wen I dey prison and wen I dey prish di trut about di gospel.
Bikos nor bi only sey di message about Christ don rish evriwhere for Masidonia and Akaia, but dem don hear di news about una faith for evriwhere. So wi nor even nid to tok about una again.