Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Korintians 3:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 Wi don dey boast about awasef again? Wi nor nid una to rite sey, wi dey good, even doh odas dey wont am like dat!

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Korintians 3:1
13 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wen Apollos one cross go Akaia, di brodas enkourage am kon gi-am leta make e give di disciples, so dat dem go welkom am. Wen e rish der, e kon join dey help di bilivers,


I get betta tins to tok about awa sista, Foebe, wey bi leader for di church wey dey Cenchrea.


Make una dey do as I dey do; bikos I dey always try to please evribody instead of mysef, bikos I wont make God save dem.


Wen I kom, I go send pipol wey una choose kon give dem leta as dem dey karry una gifts go Jerusalem.


Na God grace make mi sabi build well-well. I lay foundashon wey anoda pesin build put. But make wi take kare as wi dey build,


Bikos even if 10,000 pipol kon tish una about Christ, na only one papa una go still get. Bikos una don turn to my pikin, wen una receive di message about Christ from mi.


Wi nor go kompare awasef with doz wey sey dem good well-well or kon put awasef for di same group. But wen dem dey measure and kompare demsef with demsef, e dey show sey dem nor get sense.


Bikos nor bi who praiz ensef dey rite, but na di pesin wey God like to praiz.


Bikos if I boast small about di authority wey Jesus give us make wi take build, instead of to distroy una, I nor go shame to do am.


I don turn to fool! Na una force mi, bikos una suppose to praiz mi. Even if I nor bi anytin, e nor get anytin wey doz una “supper apostles” take betta pass mi.


May bi una dey tink sey wi dey tok dis tins to defend awasef. No! Wi dey tok to una like dis as Christ savant and na God bi awa witness. Evritin wey wi dey do, na to make una strong.


Wi nor bi like odas wey dey do God word like sey na sometin wey dem fit sell; but bikos na God send us kom, wi dey tok di trut for en present, as Christ savant.


Wi nor dey try to tok make una for sey wi dey good, but wi dey give una shance to boast, so dat una go fit ansa pipol wey dey boast with wetin eye fit si, but nor bi wetin dey dia mind.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ