Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Korintians 2:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 I rite dis leta give una, so dat I go know weda una dey obey wetin I tell una.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Korintians 2:9
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den Oga God tell Moses, “I go give una bread from heaven and di pipol go dey gada di ones wey go rish dem chop evriday, so dat I go fit test and know if dem go follow my kommandment.


And wen una don show sey una dey fear God, wi go always dey ready to ponish doz wey dey disobey God.


Na dis make mi rite dis tin give una, so dat wen I kom, I nor go kon dey vex for di pipol wey suppose make mi happy, bikos I know sey if I dey happy, una go dey happy too.


Na pain for my heart I take rite dis leta give una, nor bi to make una vex, but na to let una know di kind love wey I get for una.


So make una let am know sey una really love am.


even wen dia sofa strong well-well; dem still dey happy and wen dem nor get money at-all; dem still dey fine money give us.


So make una show dem sey, una love dem, so dat all di pipol for di church go know sey, di way wey wi dey boast about una, na true.


Doz profets wey dey si wetin go happen, make una nor listin to dem, bikos di Oga una God go dey test una, to know weda una love am with all una mind and heart.


feed una for di wildaness with manna (food wey una grand-grand papa nor ever know), so dat E go honbol and test una, den make una betta pipol.


Make una remember how di Oga una God guide una pass di wildaness for dis forty years, so dat E go fit honbol and test una to si if una go fit keep en kommand or not.


So, my friends wey I love; pipol wey dey always obey mi, (nor bi only wen I dey with una, but una dey obey well-well, even wen I nor dey with una). Make una kontinue to do God work with all una heart, so dat una salvashon go full well-well,


Una know how mi and Timoti bi, sey as pikin dey work with en papa, na so e dey follow mi work, so dat di gospel go stand.


But if anybody nor obey awa message thru dis leta, make una look dat kind pesin well-well and make nobody follow am waka or do anytin togeda, so dat shame go katch am.


I dey sure sey yu go do wetin I ask yu, so I dey rite give yu, bikos I know sey yu go do pass wetin I ask.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ