Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Korintians 2:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 So make una forgive and help am, so dat e nor go luz hope and life nor go taya am.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Korintians 2:7
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

dem for don swallow us alive as dem dey vex.


Wen Yu appear, Yu go trow dem put for fire wey dey burn well-well. God go vex distroy dem for di fire.


and E go send help kom from heaven kon save mi, den disgrace doz wey won kill mi. My God go send en goodness and love wey nor dey fail kom.


If dem sey, “Even doh di pipol dey alive and okay naw, dem go die wen wi don deal with dem finish!


Happiness dey give yu good life, but sadnes dey make pesin die small-small.


Even di profets and di priests dey stagga bikos dem don drink well-well. Dem don drink plenty wine and e dey konfuse dem. Dem don drink sotey dem nor dey fit undastand di vishon wey God send kom or judge any kase well.


Di body wey wi get naw, dey weak and e go die. But God go shange am to body wey go dey forever. So wetin dem rite for God word go kon happen sey: “Deat nor fit win di fight!”


So make una let am know sey una really love am.


Wi dey struggol as wi dey dis awa body. Wi dey karry heavy load, bikos wi nor won remove di klot wey bi awa body, but wi won wear heaven own join am, so dat life go swallow dis awa body wey fit die.


Bikos wen God make pipol sorry for di sin wey dem kommit, dem go turn kom meet am, den God go save dem and dem nor go regret again. But di vexnashon wey dis world dey bring, na deat dey end am.


Make una dey good to one anoda; dey sorry for pipol and dey forgive each oda, just as God forgive una thru Christ.


E sick well-well sotey e nearly die. But God get mesi for am; nor bi only for am, but for mi too, so dat I nor go kry join di one wey I dey so.


Make una dey bear with each oda; dey forgive each oda; even doh una get wahala with anybody. Just as Christ don forgive una, make una forgive odas too.


Awa brodas and sistas, wi wont make una know di trut about doz pipol wey don die, so dat una nor go dey sad like pipol wey nor get hope.


My brodas and sistas, wi dey kommand una with awa Oga God Jesus Christ name sey, make una nor follow bilivers wey dey do anyhow and nor dey do as wi tell dem.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ