Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Korintians 2:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 Wen I go prish di Good News for Troas, even doh Christ open door for mi,

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Korintians 2:12
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wen dem rish Antiok, dem gada di pipol kon tell dem all di tins wey God use dem do and how E open road for Gentile pipol to bilive.


Wi travel for wota from Troas and awa ship kon from der go Samotrace and di next day, wi go Neapolis


naim dem pass thru Mysia kon face Troas.


(For di room for upstair where wi for dey meet, lamp many for der),


Paul wey bi Jesus savant and apostle wey e choose make e prish God word, na en rite dis leta.


bikos plenty work dey wait for mi for der, even doh di shalenge strong well-well.


If odas dey do like dis, dat mean sey wi even get betta rite to do like dat too. But, wi dey bear evritin, so dat wi nor go kause trobol for Christ message.


Na so too God kommand sey, doz wey dey prish di gospel, go chop thru di gospel wey dem dey prish.


Bikos if I dey prish di gospel, I nor get any rizin to boast, bikos I nor fit do any oda tin dan to dey prish di gospel! Na wahala for mi, if I nor prish di gospel!


Wi nor dey do awa work pass as wi suppose do am wen wi dey with una, bikos na wi bi first to bring Christ message kom meet una.


So, if anybody kon prish anoda Christ wey wi nor prish for una and una receive anoda spirit wey una nor receive before, or anoda gospel wey una neva hear before, dat mean sey, una don asept dem well.


As I honbol mysef dey do di work, na sin I kommit? I dey do am, so dat una go fit grow up and wen I prish give una, I nor kollect money.


But even if dem use klot take kover di gospel wey wi dey prish, doz wey don lost, na only dem nor go si am,


bikos doz wey nor bilive, di gods for dis time don blind dia mind, so dem nor go si lite wey dey dis gospel wey get glory and dis gospel na Christ wey bi God image.


And di broda wey all di church dem dey praiz, bikos of how e dey prish di gospel, wi dey send am follow Titus too and


Bikos of una work, pipol go praiz God, bikos una dey obey Christ word wey una bilive and una dey share evritin wey una get with good mind.


Like dis too, make una dey pray for us, so dat God go give us betta shance to tok about Christ sekret, wey make mi dey prison.


So wi kon send Timoti, awa broda wey dey follow us do God work sey, make e kom enkourage una koncerning una faith,


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ