3 bikos una sey make I show sey Christ dey tok thru mi. Christ nor dey weak to una, bikos e show en pawa among una.
Nor bi una go dey tok, but na una Papa Spirit go dey tok thru una.
bikos I go give una di word wey una go tok and wisdom wey una enemy nor go fit oppoz.
But I bilive sey, I dey obey God Spirit wen I sey make di woman nor marry, so dat e go dey happy well-well.
Naw, mi Paul (I kwayet wen I dey with una, but my mout dey sharp naw wen I don leave una). Christ wey nor dey karry body up, wey dey gentol,
Di tins wey wi take dey fight, nor bi dis world own, but na God make am strong, so dat wi go fit skata all di strong place where wiked pipol dey. Wi dey skata trobol;
True-true for una present, wi do mirakles and wonders to show sey wi bi apostles too.
Wen una forgive pesin for wetin e do, misef go forgi-am. Bikos wen I forgive (if I really nid to forgive), I do am for Christ present, bikos of una,
Di way wey una ponish dis pesin, don rish.
God go provide evritin wey una nid. Den, una go always get evritin wey una nid and di one wey una go fit give odas.