“ ‘Anybody wey dem akuiz sey e kill pesin go dey guilty, dem go fit kill-am, if two or more pipol bear witness sey na true. But if na only one pesin tok against am, den dat one nor rish to kill-am.
Si, for di third time, I don ready to kom visit una and I nor go put my load for una head, bikos na una I wont and nor bi wetin una get. Nor bi pikin suppose pay for dia papa and mama food, but na papa and mama, dey pay for dia pikin food.
Make una nor hold anybody sey e do bad, if na only one pesin bi witness. Di trut for di matter bi sey, two or three pesin must sey dem si wetin happen.