Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Korintians 11:22 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

22 Na Hibru pipol dem bi? Misef na Hibru pesin too. Dem bi Israel pipol? Mi na Israel pesin too. Na Abraham bi dia grand-grand papa? Na dat same Abraham bi my grand-grand papa too.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Korintians 11:22
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Awa Oga God, Yu porshu doz wey dey dis land before kon gi-am to yor friend Abraham and en shidren-shidren Israel, wey bi yor pipol.


So Moses and Aaron go meet Fero kon tell am, “God wey bi Hibru pipol God sey: ‘Na how long e go take yu before yu go honbol yorsef for where I dey? Make yu let my pipol go woship mi!


“Di eldas go agri with yu, so yu and di eldas for Israel must go si Egypt king kon tell am, ‘God, wey bi Hibru pipol God don kom meet us. Naw, make yu allow us travel for three days go inside di wildaness, so dat wi go fit go offa sakrifice give di Oga awa God.’


Moses and Aaron kon sey, “Hibru pipol God don show ensef to us. So make yu allow us go di wildaness for three days go do sakrifice to awa God, so dat E nor go kill us with sickness or war.”


Den yu go tell am, ‘Na Oga God, wey bi Hibru pipol God send mi kom tell yu sey, “Make yu let my pipol go serve mi for di wildaness! But yu nor won gri.” ’


Den Oga God tell Moses, “Go meet and tell Fero sey, ‘God wey bi Hibru pipol God sey, “Make yu let my pipol go serve mi!


God kon tell Moses, “Make yu get up for early morning go meet Fero kon tell am, ‘God wey bi Hibru pipol God sey, “Make yu let my pipol go woship mi!


make una nor tink sey una don free bikos una sey, ‘Abraham na awa papa.’ Make I tell una, God fit turn all dis stone to Abraham shidren!


“I bi Jew wey dem born for Tarsus wey dey Silisia, but na for dis town I for grow, I go skool and learn awa grand-grand papa dem law well-well under Gamaliel and I get mind to serve God well-well, just as una bi today.


As time dey go, wen di disciples don plenty, di Jew pipol wey dey tok with Greek language kon dey kworel with di oda kountry-men wey dey tok Hibru. Dem kon dey komplain sey, “Wen dem dey share food, di Hibru men dey sofa wimen wey dia husband don die.”


I dey ask, God don rijet Israel, en pipol? No! Mi too, na Israel pesin, I bi Abraham pikin wey kom from Benjamin tribe.


wey bi Israel pipol, go fit asept Christ. Na dem God choose as en own shidren, E make agriment with dem kon give dem en law. Na dem get di temple and wetin God promise.


Wi know sey God make dis promise with Abraham and en pikin. God word nor sey, “to di shidren”, but e sey, “and to yor pikin,” and e mean only one and dat one, na Christ.


Dem sekonsaiz mi eight days afta dem born mi. I kom from Israel, Benjamin tribe and I bi Hibru man. I bin dey live akordin to di law, bikos I bi Farisee.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ