20 Una like make pesin turn una to slave; use and shit una; take evritin wey una get, den beat and slap una anyhow.
I dey open my back to pipol wey dey beat mi. I nor dey stop dem wen dem dey curse mi; even wen dem dey pul di hair wey dey my face komot.
Pesin wey dem slap for one side, make e turn di oda side. Make e nor tok wen en enemies dey curse am.
Woman wey en husband don die, dem dey kollect en propaty and dem dey pray long prayer make pipol for si dem. Na dia ponishment go worse pass.”
If anybody slap una for face, make una turn di oda side gi-am too. If anybody use force kollect una koat, make una gi-am una shirt join too.
Even today, wi dey hongry for food and wota, na only rag wi get to wear. Dem dey trit us anyhow and wi nor get house to stay.
Wi nor dey try to force una to bilive us; wi know sey una faith strong well-well. But wi dey work with una so dat una go dey happy well-well.
pipol wey dey karry body up; doz wey nor wont make odas know God and as wi dey do like dis, pipol dey obey Christ.
But I dey fear sey, just as di snake deceive Eve with en wayo, una mind fit spoil komot for di true and di way wey una dey follow Christ.
Even if e bi like dat, I nor put my load for una head. But dem sey, bikos I bi wayo pesin, I dey deceive una!
Dem diskuss dis matter, bikos of di fake brodas with dia wayo wey dem take dey spy di freedom wey Christ give us, so dat dem go fit make us dia slave.
Hagar bi like Mount Sinai for Arabia kountry and na di same with Jerusalem wey dey naw, bikos e dey inside der as slave with en pikin.
Na so e bi with us wen wi small; wi dey under di pawa wey dey kontrol dis world,
But naw wey una don know am (or abi make I sey God don know una), why una still dey follow all dis weak and yeye pawas? Una won bi dia slave again?
Make una nor dey karry load for head like slave again, but make una stand strong for groun, bikos Christ don make us free.
I get mind sey, God nor go let una listin to anoda pesin. But di pesin wey dey konfuse una, go face judgement, no matter who e bi.
Pipol wey won show sey dem good, dey try to force una to sekonsaiz. Dem dey do so, so dat dem nor go sofa, bikos of Christ cross.
Dem go end for hell; na dia belle bi di god wey dem dey serve. Tins wey suppose make dem shame, naim dey make dem happy and na only tins for dis world dem dey tink about.
As una know, wi nor ever try to win una with sweet words. And God na awa witness sey wi nor dey pritend to bi una friends bikos of una money.