Even doh I dey tok on my own, I nor tink sey God go tok anytin difren from wetin I dey tell una about marriage. Di only tin wey I fit do na to give una my advise. If yor wife nor dey follow Christ, but e sey e go follow yu stay, make yu nor drive am.
Koncerning pipol wey neva marry before, I nor get any kommand from Christ to give una, but I go advise una as pesin wey una fit trust, bikos God dey show mi mesi.
But if anybody for Masidonia follow mi kom meet una, den e si sey una neva ready to give, shame go katch us, (I nor go tok too mush) bikos wi trust una.