14 E nor sopraiz us, bikos even Satan dey pritend sey en na angel wey get lite.
But I dey fear sey, just as di snake deceive Eve with en wayo, una mind fit spoil komot for di true and di way wey una dey follow Christ.
so dat Satan nor go deceive us, bikos wi know en wayo.
But if wi (or angels wey kom from heaven) tish una difren tins from di one wey wi prish give una before, make God distroy us with fire!
Bikos, wi nor dey fight against human being, but na against di wiked rulers wey dey for dis world, against evil spirits and pawas wey dey di heavens.
Make una dey tank God, bikos E don make una share from wetin en pipol get for en kingdom wey dey give lite.
E save us from darkness pawa and put us for di kingdom wey E give di pikin wey E love.
Dis dragon na di old snake wey bi di devil or Satan, wey dey deceive di world. Dem trow am kom down from heaven with en angels.