God wey dey mighty still tell Jerusalem pipol: “Make una nor listin to wetin doz lie-lie profets dey tell una; na yeye hope dem dey give una. Nor bi wetin I tell dem, dem dey tell una, but na wetin dem tink and like, dem dey tok.
Bikos dis kind pipol nor dey serve awa Oga God Jesus Christ, but na dia belle dem dey kare for. With dia sweet and wayo mout, dem go praiz and deceive pipol wey nor wise.
So e nor sopraiz us sey, en savants dey pritend too like sey dem bi savant wey dey do wetin good for God eye. For di end, dem go gain wetin fit di tins wey dem dey do.
Wi nor bi like odas wey dey do God word like sey na sometin wey dem fit sell; but bikos na God send us kom, wi dey tok di trut for en present, as Christ savant.
But wi don stop to dey do wiked tins wey pipol dey hide dey do; wi nor dey do wayo or lie join God word, but with trut wey evribody fit si, wi dey make evribody know for dia mind sey, wetin wi dey do, dey good for God eye.
So make wi nor bi like shidren wey breeze dey karry up-and-down; shidren wey dey follow yeye tins wey human being dey tish and na dis tins dem dey take deceive pipol.
Bikos I don tell una before and I dey tok am again with tears for my eye sey, di way many pipol dey bihave, dey show sey dem bi enemies to Christ cross.
Make una take kare and nor let anybody fool una with wayo tok about human being wisdom and spiritual pawas wey dey rule di world, but make una dey do as Christ wont.
My shidren, di world don dey end and just as una hear sey, anti-Christ dey kom, make una know sey many anti-Christ don already kom. And dis show us sey di world go soon end.
My friends, make una nor bilive evribody wey sey na God Spirit dey tok thru am. Una must test am to know weda na God Spirit e really get. Bikos many fake profets dey for dis world.
Some pipol don hide join una and God don mark dem for distroshon. So I won tell una about dis tins sey, dis pipol nor dey fear God. Dem don dey use God grace as eskuse to dey do bad-bad tins. Dis pipol nor gri asept Christ as dia Masta and Oga God.
So dem seize di beast and di fake profets wey dey help am do mirakles to deceive pipol wey kollect di beast mark and woship en image. Den dem trow dem two inside di fire wey sulfur dey and di fire burn dem alive.
I know yor work. I don si evritin wey yu do and even as yu dey wait with patient. I know sey yu nor like wiked pipol. Yu don test pipol wey sey dem bi apostles, but dem nor bi, bikos yu si sey, dem dey lie.
But dis na wetin I get against yu: yu allow dat woman, Jezebel, make e dey do wetin e like. Dat woman wey koll ensef profet and di tins wey e dey tish dey make my savants sin, bikos dem dey sleep with who nor bi dia husband or wife and dem dey chop juju food.
I know di sofa wey yu sofa and how yu nor get money, but yu get enough money. I still know di bad tins wey dem tok about yu. Dem sey dem bi Jew pipol, but dem nor bi Jew, bikos dia sinagog, na Satan own.