If odas dey do like dis, dat mean sey wi even get betta rite to do like dat too. But, wi dey bear evritin, so dat wi nor go kause trobol for Christ message.
So, wen I dey plan dis tins, I nor tink before I do am? Wen I dey plan, I dey plan bikos of wetin I wont? Or na bikos I ready to sey, “Yes, yes” or “No, no” at wons?
Wen I nid anytin for di time wen I dey with una, I nor put my load for anybody head, bikos awa brodas wey Masidonia dey give mi evritin wey I nid. I nor allow mysef to bi problem for anybody and I nor go ever do am.
Wi nor dey try to tok make una for sey wi dey good, but wi dey give una shance to boast, so dat una go fit ansa pipol wey dey boast with wetin eye fit si, but nor bi wetin dey dia mind.